HU BI CROSSEXAMINED?

Cross Examined don dey folo oda pipol wey bi kristianprisha, wey bi kristian riter and kristians wey get plenty mouth as dem want make kristians fit dey live, undastand and fit defend wetin dem biliv, even as awa culture and wetin wi dey biliv gangan dey dey different, but make dem fit get ogbonge and confam argument and pruv fo kristianity.

Cross Examined Africa dey folo wtin di apostle’s biliv as basis fo wetin wi biliv:

CROSSEXAMINED MISSION

Kristiaity no fit dey true, or any oda tin wey pipol biiv (including all dose pipol wey biliv sey God nor dey exist), if trut na jus aw persin tink am or jus sey “e true fo yu but e nor true f

If miraku nor dey happun, den kristianity na rubbish. Wi biliv sey no bi only set Miraku fithappun but di Miraku wey dey ogbonge pass don happun and wi get pruv from scienc

Word of God nor fit dey unless sey God dey exist. Wi biliv sey three argument dey wey persin fit use shiw sey God dey exist, two na fo science and one na fo filosofi, wey bi sey wi nor nid us

Only if trut dey, God dey and Miraku fit happun, naim di New Testament go bi true. But aftawi don pruv all dese point, wi fit show rison sey di New Testament dey true akordin to oldold Tori and sey Oga Jisos die and still wake up from di dead to save man. To add to am nasey, if di New Testament dey korect e dey show sey di Old Testament sef dey korect.

CROSSEXAMINED CHALLENGES

Trut wey dem don shange make e be like lie:

Trut dey stand on en own gidigba, dem dey find am nor bi sey dem go jus tok anytin wey dem want. To dey lie giv persin na to try shange di trut, either sey yu dey do am bikos yu dey do malice or yu no rili sabi, but pass as e dey bifor di plenty pipol dey lie to cover trut fo dis Africa.

Biliv wey nor gree about man, aw di world dey and God

As natural disaster dey increase, sickneww wey dey fo di world and fear, fight fo wetin dey true don come out. Wetin bi di trut abot dis awa world, about man and God. Fo CrossExamined wi dey tackle kweshions wey dey important fo dis life of aw evritin start, awa pupose, wetin bi gud or bad and life weynor get end.

To nor get di skill to dey folo pipol tok about deir culture

Many pipol jus dey folo wetin pipol dey tok pass and dey do fo deir culture, di kweshion na sey, shey en dey disturb wetin wi dey sabi about wetin wi biliv? Wi biliv sey na so e dey happun. Different culture deyget different idea whether sey e dey akordin to faith or e wan dey like di trut. Fo CrossExamined Africa wi want folo yu tok and make yu sabi and get di skills fo all dis mata about awa culture fo beta way.