Pipol wey dey against Krist wey dey wit us

Di Shosh of Satan start by Anton Lavey for 1966 as one riligious grup wey no biliv for God and dem dey luk only on enjoyment and to dey folo wetin dey law. Pipol wey dey folo di Shosh of Satan tok sey dem no dey biliv for Satan or worship am, but dem dey try to run afta wetin dem koll “doing tins wey yu go enjoy well-well.” E dey funny sey Satan’s most pawafu tool against human bin no bi to diciv pipol to worship am, but to make dem worship demsefs insted of di Ogbonge God. Weda Lavey sabi am or no sabi, for real life, e don build one shosh of Satan wey dey worship di main tin wey Satan wan make pipol dey worship. Wetin mata no bi wetin Satan tink about imsef, but if e fit make pipol biliv for demsefs and dey luk down on God, den im work don komplete. For gardin, Satan no ask Eve to worship am, e just wan spoil Eve konesion wit her kreator. E no bi dis kain klear satanic waka wey dey shake di shosh for Amerika, but na one difrent, more dangerous and wiked Shosh of Satan wey don enta inside awa own riligious places of awa time. Di ril Shosh of Satan dey hide for where wi suppose fit see am, public eye. Satan’s true plan fo di Shosh na di same as im plan for gardin, and wi gats expose am for wetin e bi so dat wi no go jus siddon dey luk like Adam do, dey watch as dem diciv pipol. Yu fit tink sey na too much drama, but history and baibul show sey e no bi so. Di gates of Hell no go fit ovakom di shosh (Matthew 16:18), but Satan dey build im own shosh inside wetin pipol dey si as di shosh for di West, and na only smol pipol get di mind to shalenge am. Di shosh for Amerika dey quick dey fol dey turn away from wetin dem biliv. Based on one findin wey neva tey, 60% of Amerikan Kristians wey dey describe demsefs and dey unda di age of 40 biliv sey Jesus no bi di only way to salvashion. One go tink sey based on wetin Jesus tok, dem no sopose fit koll demsefs Kristians, bikos Jesus tok sey nobody fit kom to di Fada unless thru am (John 14:6). For many cases, dese popula Kristian shoshes no jus dey miss di minin of sin, dem dey koropt di gospel dey make sin dey luk gud, dey enjoy am, and dem dey use baibul to sopot one gospel wey dey allow and konfam sin insted make dem shange dia way and bilif in Krist. For 2000s, di Episcopalian shosh for Amerika don appoint di first Priest wey shange body to anoda genda, and for 2021, ELCA don appoint dia first bishop wey shange body to anoda genda. For May 2022, one United Methodist Shosh for Madison, Wisconsin do one Pride celebration event. For December 2021, one Lutheran shosh for Chicago get one pastor wey prish to children and e wear cloth of anoda genda. For August 2022, di First Kristian Shosh for Austin, Texas do one “family friendly” Show wey pipol dey wear cloth of genda wey no bi dia own for di komuniti. E neva tey, one United Methodist Church for Florida invite one pesin wey no biliv in God wey dey wear cloth of oda genda and na Pastor (yes, yu rid am well) kom dia service, especially to share im tory wit di smol pikin dem wey dey for shosh. “Romans 12:2 (Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind) bi like sey na Baibul vas wey don turn to sopot women wey dey wear men cloth” To Kristians, di part wey sopose shock dem pass for dis video no bi di woman wey dey wear man cloth wey dey inside di shosh, but na aw di “Pastor” dey use baibul take sopot Ms. Penny Cost’s life as life wey dey gud for God. “Well, one of di tins wey I tink dey gud about Miss Penny Cost na sey she dey remind us sey wi dey folo one God wey dey tell us sey make wi no do like oda pipol for dis world. E min sey wi sopose shange awa mind and as wi dey shange, wetin wi biliv today fit shange tomorrow if wi kontinu to dey renew awa mind. E dey nice sey wi dey serve one God wey dey tell us sey make wi dey grow and dey shange into somtin new, and no make us dey tied to di ways wey dis world dey limit us somtimes. E min sey wi sopose live difrent from oda pipol.” If pesin just rid di words wey dis “Pastor” tok, e fit no si anytin wey rong for dis simpu advice wey e give smol pikin dem. E quote baibul, tell dem say make dem live opposite to di world, and tel dem to live difrently. E bi like sey e dey folo di bilifs of Kristians wey don dey exist for long. But na di oldest trick for Satan’s book. E no bi too much tok. If pesin dey use baibul for one way wey dey sopot pride and bad behavior, e bi exactly di same tin wey Satan use take diciv Eve for gardin, and di same tin wey e use again wen e dey diciv Jesus. Satan no dey fear to use baibul take get wetin e wan pass. E dey waka dey wait for chance to catch di weak, and e dey do exactly dat thru rong minin and rong use of baibul (1 Peter 5:8). If Devil fit make pipol biliv sey dem don save based on false use of baibul, and dem go folo di rong gospel, e min sey e don finish digest dem and dem go perish. Jesus don already give expo about dis real life wen e tok sey no bi evribody wey go koll am “Lord, Lord” go enta di kingdom of heaven (Matthew 7:21). Many pipol go dey do gud tins like mercy missions, givin free monie, hep clothe and give di poor food, but dem go don folo one false gospel wey no fit save dem. Dis false gospel na di weapon wey Satan dey use against di shosh. Satan no nid Anton Lavey to get im shosh. E just nid to diciv dose wey dey koll demsefs di shosh make dem biliv one gospel wey dey full of lies and self-fulfillment. Na one old tory wey don dey happun since long time. For garden, di serpent twist God’s words to diciv Eve and make am tink sey na only hersef mata, sey she go find fulfillment and hope for kreation instead of di Kreator (Genesis 3, Romans 1). For Matthew 4:6, we si Satan still dey use baibul take try diciv Jesus for thick bush. Satan tok Psalm 91:11-12 like sey e dey make Jesus no sabi use baibul and make e put im ego above di Fada’s plan. But Jesus, of kos, no gree fall for am. John Piper tok am like dis: “Pay attention well! Satan no always dey try spoil faith by tok sey, ‘Babul no bi true.’ E often dey try distroy awa faith by confamin som passage and use am take lid us enta doing wrong tin.” If Satan use baibul take diciv Eve, and again try skata di work wey God dey do thru Jesus, e no go sorprise if e use baibul kreate one shosh wey full of pipol wey dey do sin and no get any impact. Dis na di spirit of pipol wey dey against Krist, and e dey kos sirious trobu for di Amerikn shosh. Di spirit of di pipol wey dey against God dey sopot sin, dey allow wickedness, and dey insot di name of Jesus (1 John 1:7, 2:18-22, 4:3). Di video wey dey up dere achieve all dese tins for just fifty seconds. Devil’s plan to koropt di shosh dey very klear, but e dey blind many pipol bikos of dia nature and pride. Di rong minin and rong use of Romans 12:1-2 expose di Devil’s plan. Wi dey read for 1 John 2:15-24 di komplete opposite of wetin dis pastor dey tok:
Make una no luv dis world or di tins wey dey inside am. If anybody luv dis world, di Papa love no dey inside am, bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human bin body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom. And dis world don dey fade with di tins wey pipol wont, but di pesin wey dey do wetin God wont, go dey foreva. My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, pipol wey dey against God dey kom, make una know sey many pipol wey dey against God already kom. And dis show us sey di world go soon end. Na from us dis pipol from komot, but dem nor rily dey God family bifor, bikos if to sey dem dey, dem for stay wit us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
Dis one wey wi dey si so, e dey remind us say our fite no bi against human belins but against the dark forces wey dey dis world (Ephesians 6:12). E no make sense again to koll dis progressive movement for shoses Kristian. Dem no bi progressive Kristians, dem bi progressive antichristians. Dem dey klaim sey dem be godly but dem dey deny di power wey dey inside am (2 Timothy 3:1-5). Dem dey karry pipol astray wit empty and lie-lie filosofies wey dey based on human traditions and di spirits wey dey kontrol dis world (Colossians 2:8). Dem luv evil tins and hate good tins (Romans 12:9). Satanic shosh dey evriwhere around us and dem dey klaim sey dem bi folowas of Krist just to confuse di gospel. Wi no fit gree or sopot dis open act wey dem leave di faith. Paul tok sey wi no sopose get anytin to do wit dem (2 Timothy 3:5) and Jesus tok sey dose kin of pipol, wey klaim sey dem bi agents of di Lord, go face even harsher judgment pass odas (Luke 17:2). Make I klear somtin, my konsan no dey against dose wey dey attracted to dis false gospel. E dey pain my heart for dem. Di rison wai Kristian shosh response to dis false tishin sopose quick and strong na for dem. We sopose dey filled wit mercy, patience, and grace (Jude 1:22-24). Dem dey ask one kweshion: “Aw I fit dey happy, fulfilled, and get porpose?” Di ansa dey available and wi nid to show confused pipol luv, undastandin, encouragement, and most impotantly, truth. Wi sopose koll dese pipol make dem shange dia ways; wi no sopose allow dem make dem dey proud for dia sin and dey spoil di gospel. Wi no sopose use charm to allow dem insot but to attract dose wey dey find ansas. E dey sweet to point out error and prishh make pesin shange im way for Krist (Romans 2:4). Di true shosh sopose bi like salt and light (Matthew 5:13-16). Salt dey preserve godliness for di generations and light dey expose di wicked deeds (1 John 1). Wi no fit allow dose wey wan spoil di gospel of Jesus Krist. Na time don rish for us to bold for awa faith, and if dem dey mock us, persecute us, or insult us bikos of our faithfulness to dj true gospel, wi dey folo di right path (Hebrews 11, Acts 5:42, 2 Timothy 3:11-12, Matthew 5:10-12). Wi sopose start dey koll dese kain progressive shoses by dia real name, and wi no go beg for forgiveness, bikos e dey kind to expose di wikednes wey dey happun, make dem shange dia ways and kom bak to di luv wey dem don lose (1 Corinthians 5:5, Revelation 2). I tink Kevin DeYoung tok am well: If evribody dey like us now and Jesus kom judge us as guilty lata, e no make sense. And if evribody tink sey wi dey fulish and wiked now and Jesus kom klear us lata, make e bi so.