One Dragon fo Kristmas

one place wey dem dey kip animals and dem dey chop (manger), na where di smol Lord Jesus kom lay im head. Di stars for sky luk down where e dey, na di dry grass wey dem use put fo ground, na for dere di smol Lord Jesus dey slip. Di cattle dey moo, di pikin kom wake. But di smol Lord Jesus no dey cry at all. . .Na very pisfu place. Na as evri Kristmas card dey show am. Swit baby Jesus dey make gentu sound smol-smol fo inside im manger wit plenti smiles all around. But di wahala bi sey e no show di real tori as e bi. Apart from sey Jesus go cry like any noma baby, for Revelation 12 dem tok sey di Kristmas tori get sirious batu wey dey happun for spirit world.
Di Dragon Fites
Shapta 12 show sey Revelation no dey ricod history for straight oda. Like I don argue bifor, Revelation show us difrent visions wey relate to each oda. E dey retell di same tory from difrent ways. I don make dis point bifor wen I tok about di seven seals, trompets, and bowls. Shapta 12 get im own special place bikos e dey tok about wen Jesus kom in flesh. For vas 1, John discribe vision where e si woman wey dress wit sun, stand for moon, and wear crown wit twelve stars for im head. Scholars (pipol wey sabi somtin well-well) no gree on wu di woman bi. I fit yarn sey she fit represent di pipol wey dey worship God, but som pipol argue sey na Mary. Di way di big big images take bi, e show sey dis pesin dey for big pozision, especially di crown wey get twelve stars on top her head. Wi don rid for anoda place for Revelation sey God make im pipol rulas (Rev 1:6; 5:10; 20:6). And di nomba twelve na sign sey na di pipol of God (twelve tribes and twelve apostus). Vas 2 tok sey di woman bin get belle and she dey sofa for wen she wan born. For di OT, wi don rid plenti times sey Israel go sofa wen dem wan born bifor dem get salvation from di Messiah (Isa 26:17-18; 66:7-10; Mic 4:10). For di same time, one big red Dragon wit seven heads, ten horns, and seven crowns for im head kom karry one third of di stars for heavun kom throw dem for ground. Di dragon na klear reference to Satan (Rev 12:9; 20:2). Di dragon dey try kopy Jesus wey get horns and diadems too (Rev 5:6; 19:12). Lata for Revelation 17:12, dem tok sey di ten horns represent ten earthly kings. In oda words, di dragon dey do im bad plans thru earthly kingdoms and rulas. And tho many pipol biliv sey di stars represent angels, e fit bi sey di stars represent pipol as dem tok for Daniel 8:10 wen Antiochus Epiphanes also throw down “stars”. In oda words, John dey try make di same point wey Daniel dey make: di enemy go sofa God’s pipol. As di woman born pikin, e no bi jus any pikin, but na pikin wey go rule nations wit iron staff. Dis language dey refer to Psalm 2:9: “Yu go break dem wit rod of iron.” Dis Psalm, wey dey tok about di “anointed” of di Lord (di Messiah), also dey tok sey, “Yu na my Son; today I don born yu” (Ps 2:7). Dis pikin na Jesus of Nazareth, wey go bring blessin to nations (Gen 12:3). As aw e go bless pipol? Vas 5 tok sey di pikin “karry go rish God and hin throne.” Dat min, even tho di dragon wan chop dis male pikin, e go win di fite as e kom bak afta e die and go siddon for di rite hand of di Fada. But even tho Krist don defeat Satan, di dragon still dey fite against God’s pipol while e fit. Vas 6 tok sey di woman run go hide for bush for 1,260 days (3.5 years). For dat bush, God go take kare of hin pipol, jus as e take kare of old Israel. Plenti scholars no dey gree on aw dem explain di 1,260 days, but I biliv sey e represent di time from wen Krist kom bak afta e die rish wen e go kom bak again. Di 1,260 days most likely kom from Daniel 9:27, wey tok sey di sacrifice go stop for “haf of a wik.” For dat time wey di tin happun, one wik na seven years. So haf of a wik min forty-two months or 1,260 days. Daniel bin dey tok wetin go happun for future sey Krist go die for future, and e go make di sacrifices stop for di final 1,260 days wey represent di time bitwin Krist two komin. For shapta 11, wi rid sey enemies go sofa di pipol of God for forty-two months (1,260 days). Na durin dis 1,260 days di two witnesses (wey bi di shosh) go dey tok wetin go happun for di future to di world. All dis texts dey sopot di idea sey 1,260 days refer to di present time wey di shosh dey.
Di Dragon Foll
Som pipol biliv sey Satan and im angels foll from heaven bifor humans appear, but if wi luk am well, wi go si sey di time wen di tin happun no sopot dis tok. For dis vision, wi dey si big fite bitwin di dragon and Michael. Michael na di pipol of God and e ovapawa di dragon, kom throw am down to di eart. Vas 9 tok sey “di big dragon wey dem throw down na di old snake, wey dem dey koll devil and Satan, di one wey dey diciv di whole world.” Dis images dey remind us of di snake for di garden (Genesis 3), di big sea kreature (Job 41:1; Isaiah 27:1), Rahab (Job 26:12), and di sea monsta (Psalm 74:13; Ezekiel 29:3). All dese serpent kreatures (snakes and sea monstas) na sign of Satan wey dey against God’s pipol. Wi rid sey di dragon and im angels dem komot from heaven bikos of “di blood of di Lamb and by di word of dia testimony.” E bi like sey Satan bifor dey stand for God front dey blame pipol bikos of dia sin (Job 1:9; Zechariah 3:1). But Krist die for us as sacrifice, and im silence di blamer! So Satan komot from heaven and im kontinu to dey lose as di gospel dey spred. God’s pipol still dey prish di message even tho dem sofa for am. Tho di dragon don lose, e no jus give up. E dey try bring down as many pipol as e fit.
Di Dragon dey Strogu
Tho Satan foll to earth, e still dey fite against di woman and her “pikin-dem.” Som pipol fit separate dem, but e beta make wi si dem as di same tin—di pipol of God. If wi wan split dem, wi fit si di woman as di shosh and di pikin-dem as pipol for inside di shosh. As di dragon dey try attack di shosh, wi rid sey God karry dem fly for di wings of eagles go inside bush, jus like aw e happun for di time of exodus (Exod 19:4). Again, wi si sey God dey provide food and kare for im pipol for di bush for “a time, times, and haf a time.” Dis tok simply min 3.5 years or 1,260 days. Like I don tok bifor, dis time frame represent di time from wen Jesus rise from death till im go kom bak. Minin sey, for dis korent shosh time, God dey protect im pipol from Satan attacks. For di same time, Satan still dey attack di shosh. E still dey blame, but e no fit blame wit truth since Krist don die. Im only option now na to lie. E dey very impotant, derefore, for bilivas to always rememba di gospel so dem fit fite against Satan blames. Even tho Satan dey bring fite, God go pata-pata protect im pipol and bring dem safely go dem real home.
Di Pesin Wey Fit Kill Di Dragon
Di tori of di Baibul, na so e dey tok sey Jisos kom as di pikin of di woman to mash di head of di snake. For inside Baibul, wi dey si signs sey di dragon dey fite against God pipol thru pipol like Pharaoh, Goliath, King Herod, and di Jewish lidas. But as wi dey si for Revelation 12, na di great snake dey kontrol evritin. But even tho dis dragon strong, e no fit stand up against di great dragon-killa Jisos. Wi rid of di way di dragon die pata-pata for Revelation 20:2-10 sey, “E kom cash di dragon, wey bi di old snake wey bi devil and Satan, e tie am for one thousand years, e kom throw am inside one big hole and lock am wit seal so e no fit diciv di nations again until di one thousand years finish… And di devil wey diciv dem, e kom throw am inside di lake wey dey burn wit fire and sulfur where di beast and di fake profet dey, and dem go sofa day and nite foreva and eva.”